https://www.bbc.com/pidgin/articles/cm2yp58pj9zoDi State of Emergency wey President Bola Tinubu impose for Rivers State on Tuesday night go officially take effect if two-third of di members of di National Assembly vote to approve am.Dat na according to di Nigeria constitution, and e dey expected say di lawmakers go meet today to vote on di matter.BBC dey monitor di situation and go bring you di tori as soon as e happun.Di announcement by President Tinubu surprise many Nigerians and already, plenty political sabi pipo and groups don dey chook mouth.Tinubu tok say e take di decision sake of how di political crisis for Rivers State dey get worse and e don lead to destruction of federal goment oil infrastructure for di state."No good and responsible president go standby and allow di grave situation to continue witout taking remedial steps prescribed by di Constitution to address di situation," Tinubu tok as e invoke section 305 of di Nigerian constitution to declare a state of emergency for Rivers state.>Wetin dey section 305 of Nigeria constitution?For Nigeria, na section 305 of di constitution give di president power to declare a state of emergency, and di conditions for dat include:- If di kontri dey for war- If real danger dey say di kontri fit dey involve for war, or say di kontri fit dey invaded- If actual breakdown of public order and public safety for di kontri or any part of di kontri dey, wey require extraordinary measures to restore peace and security;- If danger dey say breakdown of public order and public safety fit happen for di kontri or any part of it, and extraordinary measures dey necessary to avoid am- If ogbonge natural disaster happen for di kontri or any part of am, or if danger dey say big natural disaster fit happen wey go affect pipo wella for di kontri- If any oda public danger dey wey go be threaten di existence of di Federation- If di governor of a state, wit support from di state assembly, ask di president to do so
>Wetin be state of emergency and wetin dey happun during dat time?State of emergency na situation wia goment get power to do tins wey normally e no fit do, in order to make sure say lives and property of pipo dey secure and di situation no continue to dey get worse.During dis period, some human rights of pipo fit dey suspended depending on di seriousness of di matter wey cause di declaration.But as e be now for Rivers State, even though President Tinubu tok say di state of emergency don take effect from Tuesday, 18 March, 2025, sabi pipo tok say Govnor Siminalayi Fubara go still dey in charge until di National Assembly vote in support of Tinubu for dis matter.Tinubu don already nominate retired navy Vice Admiral Ibok Ete Ekwe Ibas as di sole administrator wey go dey in charge of Rivers State for an initial six months period wey di state of emergency go last.Di constitution also give di president and di national assembly power to extend am by anoda six months if necessary.E dey expected to see say di presence of military personnel go increase now for Rivers State, especially as President Tinubu bin tok say e don cut dem serious warning to protect lives and oil pipelines for di state.Also, e dey possible say dem fit declare curfew and restrict movement during dis period.>Timeline: Oda times Nigerian presidents declare a state of emergencyDi last time wey dis kain tin happen for Nigeria na 12 years ago, wen President Goodluck Jonathan declare state of emergency for three states in di north east region - Adamawa, Borno and Yobe States - sake of Boko Haram insurgency.Dis na di oda times wey state of emergency don dey declared for Nigeria:
Plateau State - 2004:Olusegun Obasanjo, wen e be President of Nigeria for 18 May, 2004, bin declare a state of emergency for Plateau State afta one ogbonge religious katakata bin happen for di state.Obasanjo suspend di govnor dat time - Joshua Dariye - and appoint Chris Alli, a retired army general - as di sole administrator.Di situation bin last from 18 May until 18 November, 2024, wen Dariye return to office.Ekiti State - 2006:Obasanjo also declare a state of emergency for Ekiti State on 19 October, 2006.Dis na wen di state get political wahala wey almost cause breakdown of law and order afta di state lawmakers bin impeach Ayodele Fayose wey be di govnor dat time.Obasanjo bin appoint a retired brigadier general of di Nigeria Army Adetunji Olurin to be di sole administrator of di state.Olurin dey dat position reach April 2007 bifore e hand over to Tope Ademiluyi as acting govnor.Adamawa, Borno and Yobe States - 2013As boko haram insurgency start to dey get worse for di north east region of Nigeria for 2013, Goodluck Jonathan wey be Nigeria president dat time declare a state of emergency and impose curfew on Adamawa, Borno and Yobe states wia di insurgents bin dey disturb pass.During im national broadcast on 14 May, 2013, Jonathan tok say di actions of di boko haram fighters "amount to a declaration of war, and we go hunt dem down, we go fish dem out, and we go bring dem to justice."But Jonathan no suspend di govnors and state assemblies of di three states.
>>1393597pidgin anon! Aw we missed you buddy.
>the absolute state of England
>>1393600I hate pidgins. They shit all ova side of muh building. Dey don even taste good. Dey eats lot of American foods and taste like fat Americans.
>>1393597Nigeria is headed for a revolution soon and probably not in a good way.