View Announcement Janitor applications are now being accepted. Click here to apply.
Anonymous 'We don catch am' - Authoritie(...) 09/12/25(Fri)21:37:07 No. 1435952 https://www.bbc.com/pidgin/articles/cr4q2zg9rz3o Dem shoot Charlie Kirk, one influential right-wing activist and close ally of US President Donald Trump, on Wednesday,10 September, as e dey tok for one event for one university for Utah. On Friday, 12 September, President Donald Trump tok say di suspect dey for custody, for one interview wit Fox News: "I think we get am." "Essentially, na pesin wey dey very close to am turn am in." Na Oga Trump, too, bin first announce say im paddy, Kirk, don die afta dem shoot am for neck for Utah Valley University on Wednesday. BBC US partner CBS report say one law enforcement source don identify di pesin for custody as 22-year-old Tyler Robinson. Di arrest come less dan one day afta FBI release one blurry foto of a "person of interest" wey dey wanted for di shooting. Investigators bin beg di public to help identify di suspect, wey wear sunglasses, Converse shoes and one "distinctive" long-sleeved black top wey feature American flag and one eagle. For one press conference on Thursday night, Utah govnor Spencer Cox bin also release one video of wetin police believe say na di suspect as e dey run from di scene. Di FBI earlier dat day bin tok say dem recover one high-powered firearm - one imported Mauser .30-06 bolt action rifle – wey dem wrap for towel for one wooded area.>Wetin hapun? 31-year-old Kirk, bin dey tok for Utah Valley University for Orem on 10 September, 2025 as part of im "American Comeback" tour. E sit down under one white gazebo to take questions from crowd of about 3,000 for di university "quad", one outdoor courtyard. E bin dey ansa questions about mass shooting. Den one single shot fire, wey pipo believe say come from di roof of di Losee Center, one building wey dey overlook di quad. Kirk come fall from in chair wit clearly visible wound for im neck. E dey bleed seriously and im staff carry am comot for stage. Di crowds around di tent begin run and pipo begin shout. >>
Anonymous 09/12/25(Fri)21:38:00 No. 1435954 >Wetin we know about di suspect? Di name of di suspect wey kill US activist Charlie Kirk na Tyler Robinson, and e be 22-year-old, according to BBC US partner CBS. Two sources tell BBC US partner, CBS, say Robinson dey live for Southern Utah and e clearly don confess to im father. For one FBI news conference, Utah govnor, Spencer Cox confam say: "We don catch am." Oga Cox tok say investigators review video footage, and dem identify Robinson as e land di area inside one Dodge Challenger vehicle at approximately 08:29 local time on 10 September. Utah govnor say di suspect, Tyler Robinson, no be student for Utah Valley University - wia di shooting hapun. Spencer Cox add say im no get any information about if Robinson get history of mental health illness. Robinson for a long time bin dey live wit im family for Washington county, for south west Utah, about three hours away from di university, di govnor tok. Wen investigators see am on 12 September, dem see say na di same cloth wia e wear for dat footage dem share, one "plain maroon t-shirt, light-coloured shorts, a black hat wit one white logo and light-coloured shoes", na im still dey im body. Cox say one family member of di suspect bin tell investigators say Tyler Robinson don become "more political" in recent years. E say di family member recall one recent incident wen Robinson come dinner bifor 10 September and e mention say Charlie Kirk go dey Utah Valley University, and dem ask why e "no like am and di viewpoints e get". Robinson bin tell one family member say "Kirk dey full of hate and e dey spread hate", according to Cox. Di govnor later say e hope dem go file charging documents early next week.>>
Anonymous 09/12/25(Fri)21:39:02 No. 1435955 >Timeline of how dem capture di suspect During di news conference earlier, FBI director Kash Patel give timeline of di events wey lead to Tyler Robinson capture inside 33 hours. At 12:23 local time on Wednesday 10 September, dem shoot Charlie Kirk Within 16 minutes, di first agents don land and secure di scene at 12:39 Di FBI "immediately launch fixed-wing assets" (aircrafts) to transport special personnel and evidence FBI release di first set of fotos of di suspect at 10:00 local time yesterday At 10:45 local time on Thursday, FBI announce a reward of $100,000 to give informate on suspect Patel land di scene at 17:30 At 20:00 di govnor lead press conference wen dem release video and images of di suspect And at 22:00 last night authorities take di suspect into custody>>
Anonymous 09/12/25(Fri)21:47:14 No. 1435959 >>1435952 Based pidgin poster. /news/ is healing.>>
Anonymous 09/12/25(Fri)22:01:57 No. 1435967 Where be kept you when kash patel said us gonna find the shooter, then captured two of the wrong pipo, then the shooters dad turn em in? Where be kept you when Donald Trump say Wednesday even'n on the TV that dem radical lefts did et, but den dere was no suspect catch, and then the catch people na no democrat at all? Where be kept you when Donald Trump make a FAKE NEWS? >>
Anonymous 09/12/25(Fri)23:57:03 No. 1435992 >>1435967 I don't know what to tell you, pidgin poster.>>
Anonymous 09/13/25(Sat)00:03:55 No. 1435995 >>1435959 Pidgin is eternal>>
pork laintinxer. N'YUCK N'YUCK(...) 09/13/25(Sat)00:24:02 No. 1436001 >>1435967 Ashkay atelPay isay competentinay oolfay
Delete Post: [ File Only] Style: Yotsuba Yotsuba B Futaba Burichan Tomorrow Photon
All trademarks and copyrights on this page are owned by their respective parties. Images uploaded are the responsibility of the Poster. Comments are owned by the Poster.