[a / b / c / d / e / f / g / gif / h / hr / k / m / o / p / r / s / t / u / v / vg / vm / vmg / vr / vrpg / vst / w / wg] [i / ic] [r9k / s4s / vip / qa] [cm / hm / lgbt / y] [3 / aco / adv / an / bant / biz / cgl / ck / co / diy / fa / fit / gd / hc / his / int / jp / lit / mlp / mu / n / news / out / po / pol / pw / qst / sci / soc / sp / tg / toy / trv / tv / vp / vt / wsg / wsr / x / xs] [Settings] [Search] [Mobile] [Home]
Board
Settings Mobile Home
/news/ - Current News

Name
Options
Comment
Verification
4chan Pass users can bypass this verification. [Learn More] [Login]
  • Please read the Rules and FAQ before posting.

08/21/20New boards added: /vrpg/, /vmg/, /vst/ and /vm/
05/04/17New trial board added: /bant/ - International/Random
10/04/16New board for 4chan Pass users: /vip/ - Very Important Posts
[Hide] [Show All]


New anti-spam measures have been applied to all boards.

Please see the Frequently Asked Questions page for details.

[Advertise on 4chan]


https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjdl3yy80zdo

Emergency workers for Spain dey work around di clock to find pipo wey dey miss afta flash flooding wey happen between Tuesday and Wednesday don kill more dan 200 pipo so far.

But more rain dey expected to fall on Friday and Saturday in some places.

E neva dey clear how many pipo wey dey miss but goment don send hundreds of soldiers to di province of Valencia wey be one of di worst-hit areas, to help wit di rescue operation.

For some areas, di equivalent of one year rain na im fall for inside just few hours, and e cause massive floods wey sweep away towns and trap plenty pipo for inside dia house.

For some places, na only helicopter fit go dia becos mud, debris and piles of cars don block di road. One BBC tori pesin say communities dey devastated.

Spain don declare three days of mourning for di pipo wey die.

Di rainfall wey come wit strong winds and tornadoes na as a result of wetin sabi pipo for weather mata dey call DANA - Spanish acronym for high-altitude isolated depression.

E affect large areas for di south and east of Spain.

Reports dis Friday morning tok say di "Dana" weather system wey cause di flooding rainfall don dey weaken now, but more rain dey expected to fall on Friday and Saturday for some places.

Rainfall warnings dey in place for areas wey dey north of Valencia - especially around Tarragona and Castellón regions, as well as Menorca and Mallorca. Also for south-west Andalucía around Huelva and Condado.

For dis regions, rainfall fit reach 100mm ova di next 12 hours. As di ground don already dey saturated wit water, e fit cause even more flooding.

But di rain suppose calm down by Saturday, and a much weather dey in di forecast across Spain by Sunday.

Spanish Prime Minister Pedro Sanchez tok say flood victims "no go dey abandoned" and say dem go rebuild towns and cities wey di floods affect.
>>
Di President of di European Parliament, Roberta Metsola, also express her solidarity wit all di pipo wey dey affected and she also tank di rescuers "wey dey do evritin possible to help pipo in need."

Insurance analysts say di floods on Tuesday and Wednesday go be di costliest natural disaster ever to hit Spain, according to Spanish newspaper El País.

One thousand relief workers don dey deployed to assist wit rescue operations.

Due to di heavy rains - di heaviest for almost one century - many pipo bin spend di night on top of dia cars as dem dey wait to dey rescued.

Di central goment say trains and flights dey severely affected as cancellations don plenty.

Also, about 150,000 pipo no get electricity sake of di disaster.

Di term DANA na wetin meteorologists for Spain start to dey use some decades ago to differentiate am from di more generic word “gota fría” (cold drop).

E dey usually refer to any situation of too much rainfall, especially wen e happen for di Mediterranean coast of di Iberian Peninsula during di autumn.

DANA na phenomenon wey be say mass of veri cold polar air dey isolated and begin to dey circulate at veri high altitudes (between 5,000 and 9,000 metres), far from di influence of atmospheric circulation.

Den wen e collide wit di warmer and more humid air for di Mediterranean Sea, e go generate strong storms - especially for di end of di northern summer and beginning of autumn, wen sea temperatures dey higher.
>>
>>1358860
lmao I read the title in the catalog and as soon as I say "dey" I said to myself "oh no don't tell me they did the pidgen thing again" lmao it never gets old
>>
Di rain for spain no fall mainly for di plain
>>
very interesting tori
>>
Hunter Biden caused this
>>
>>1358860
bump eu story



[Advertise on 4chan]

Delete Post: [File Only] Style:
[Disable Mobile View / Use Desktop Site]

[Enable Mobile View / Use Mobile Site]

All trademarks and copyrights on this page are owned by their respective parties. Images uploaded are the responsibility of the Poster. Comments are owned by the Poster.