Anonymous Nigerian atheist free from pri(...) 01/08/25(Wed)03:55:47 No. 1373134 https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4gln8nlmz4o Nigerian atheist wey dem just free afta serving more dan four years in prison for blasphemy, dey live for one safe house as im legal team dey fear say im life fit dey in danger. Dem convict 40-year-old, Mubarak Bala for one court in di northern city of Kano afta, e plead guilty to 18 charges relating to one Facebook post wey cause gbas-gbos in 2020. "Di concern about my safety dey always dey dia," e tell di BBC for exclusive interview as e dey chop im first meal as free man. Nigeria na deeply religious society and pipo wey insult religion - weda Islam or Christianity – dey face discrimination. Blasphemy na offence under Islamic law – Sharia - wey dey operate alongside secular law for 12 states in di north. Na also offence under Nigeria criminal law. Bala, wey renounce Islam in 2014, say e get times during im imprisonment wey im feel say "e fit no come out alive". E fear say guards or fellow inmates fit dey target am for di first prison e dey for Kano, mainly Muslim city. "Freedom dey hia, but some kain threat still dey wey I dey face," e tok. "All dis years, di threats, e fit dey out dia." E fit dey inside prison for much longer if no be appeal court judgement wey reduce di initial 24-year sentence last year, describing di sentence as "excessive". Bala look tired as e waka comot from prison for di capital city Abuja, but e dey cheerful as e wear white T-shirt, khaki shorts and slippers. E come out wit im lawyer by im side. "Evri tin dey new to me. Evri tin dey new," E tok as im embrace im freedom. Bala, na bold religious critic, wey dem arrest afta one group of lawyers file complaint wit di police about di social media post. E den spend two years for prison awaiting trial bifor dem convict am in 2022. At di time Bala guilty plea shock many, even im legal team, but e stand by im decision, saying e go relieve di pressure on di pipo wey stand for im side, including im lawyers, friends and family. >>
Anonymous 01/08/25(Wed)03:56:04 No. 1373135 "I believe say wetin I do save my life, and di pipo of Kano," e tok. "Especially pipo wey dem attach to my case, becos dem dey also target dem." Bala conviction dey widely condemned by international rights groups and e cause kasala about di freedom of speech in Nigeria. Im detention also send shockwaves across Nigeria small atheist and humanist communities, and im release come as relief to many, but concerns still dey. "Na thanks and no thanks," Leo Igwe, di founder of the Humanist Association of Nigeria, tok. "Thanks, say e don come out, thanks say e be free man. But no thanks, becos dem don spoil im image as if say e commit crime. For us at di Humanist Association, e no commit any crime." As for Bala, e wan catch up on lost time – including getting to know im young son wey bin dey six weeks old wen dem imprison am. But e tok say e no get any regret. "My activism, my posting on social media, I always know say di worst go happun, Wen I make di decision to come out, I know say dem fit kill me. I know di dangers, and I still decide to do am." >>
woke WANKandian wakes 01/08/25(Wed)04:52:24 No. 1373137 I demand Ni*eria change it's name. Princeria is a good name. >>
Anonymous 01/08/25(Wed)21:01:55 No. 1373293 based pigmi poster
Delete Post: [ File Only] Style: Yotsuba Yotsuba B Futaba Burichan Tomorrow Photon
All trademarks and copyrights on this page are owned by their respective parties. Images uploaded are the responsibility of the Poster. Comments are owned by the Poster.